Читать книгу Mami Wata - Oluwagbemiga Ogboro-Cole - Страница 6
»Mami Wata« Introduction
ОглавлениеPidgin English dem don say »di language no get head« dat na so di book pipul for Nigeria and di Christian oyinbo pipul wey come for our land Naija long long time ago.
Wetin come dey surprise me now for Naija today, mani mani pipul come see say our language Pidgin English dey veri veri important naim mak pipul like, Proffessor, Musican, Religion pipul, and our gofument too come see am too.
For our country Nigeria wey bi say language plenty well well wit 36 state and Abuja our head for all di state wey we get for Naija, wey show say we dey speak like almost 250 langauges.
All dis language no even bring we naijas together for di sake of say we no fit to talk to each other with one language and di tin be say e no help we. And instead mak di tin help na divid e dey divid us. Our book pipul and gofument dem don try make we for get another language. Dem try sote come try di language we dem call WAZOBIA.
Di problem bi say di onli language wey we all dey talk take understand each other dem come band am, say di tin no bi language say Pidgin English no get head say dem no go take am as language for our land Naija.
Di tin wey make me write dis book for Pidgin English na for di same reason we bi di down look wey dem dey take see anibodi wey talk for Pidgin English wey dem no wan take as language for Naija.
»Mami Wata« na stori book wey I write for Naija Pidgin English, wey bi popular language, wey mani mani pipul dey talk for Naija.
Naija Pidgin English dey different from all di 250 languages wey we dey talk for Naija, di reason wey Pidgin come bi di language wey pipul dey talk today na because of our young children dem wey come see say Pidgin English no dey bad at all as dem take teach dem for school. Dem tell us wen we dey like pikin say Pidgin English no bi good language say na bad language wey person wey go school mus not speak.
Our children dem don see Pidgin language as wonderful language, naim come make dem dey use am for dem music today wey dem dey call rap or hiphop.
Pidgin hiphop don nearly over take all di music wey dey for naija today, but we no fit talk about di reason wey Naija Pidgin English come popurlar today make we no tank di pipul wey start dey use use am.
Pidgin English for Naija today, we no fit dey write about am make we no call di name of di papa dem all wey make di language watin e bi today.
Pipul like Baba Abami eda »Fela Anikulapo« wey dey use di Pidgin dey write im music wey dem dey call Afro Beat wey come dey popular today for Naija and di world, we mus not forget pipul like Bola Johnson wey bi di first person wey come write Naija Pidgin Newspaper for Naija.
»Mami Wata« na human fish wey dem dey call »Mama of all river« wey bi say for all Yoruba stori dem dey use Mami Wata as God of river dem wey dey give anybody wey see am or ask for anitin like richness and all di fine fine tin wey person want.
Mami wata today na like God like di Christian and Muslim religion, for Naija e get pipul wey dey worship am as dem God and e dey gif dem watin dem want from im.
Some pipul dey call »Mami Wata« Yeye Osun »Mama Osun river« wey be also di history for Yoruba Land wey come from history of how we di Yoruba come for di world, and all di worior dem wey don help Yoruba land and im pipul.
Osun river dey for Osun state for Naija till today wey mani mani pipul from all di world dey come worship.
Mani mani Yoruba stori wey dem dey use animal for inside, dem dey take am talk to small small pikin dem. Dem dey use am mak dem for no why animal bi dis or dat.
After I come look wel well for inside di stori wey dem dey tell small pikin dem for Yoruba land, I come see say dem jus use different animal for di stori dem to fit describe how animal dey clever and how im bodi or how e dey run or slow. So na all dis tin dem naim dem dey talk with small pikin dem make dem for know watin dey good and bad.
Tortis na one of di animal wey be say e day for almost di stori for Yoruba land, and tortis for Yoruba stori e dey do good and e day do bad, so everi pikin dey use mak e no watin good and bad.
Yoruba stori na from generation to generation wey be say e most continue to go from one person to other and our pikin pikin wey bi Yoruba pikin.
Di stori wey dey inside »Mami Wata« na for mai pikin time wey mai mama tell me wen I dey small. Mai mama tells me di stori for Yoruba, I come retell am for Naija Pidgin English.