Читать книгу Mami Wata - Oluwagbemiga Ogboro-Cole - Страница 8
Kosikosi wit Im Magic Yam Cube
ОглавлениеE get one time way one boy pikin, come for dis world as dem born di pikin, e come wit one veri small cube of yam for im hand, and dis yam cube come get magic inside, dis boy begin grow and grow but as im dey grow di cube of yam no dey grow di tin still dey as e bi wen dem born am. Im papa and mama come gif am name »kosikosi«.
Di yam cube come get powerful magic wey bi say di cube of yam no even rotten at all as im dey grow na so di yam cube dey dey fresh.
One day im mama and papa come tell am say make im go bring fire wood come for bush wey dem go take cook for evening, so Kosikosi put head for bush say make e go bring fire wood come. Kosikosi come fine mani mani fire wood, as e wan tie all di fire wood together e come put im cube of yam veri veri near di firewood, after e tie am finish e come forget im magic cube of yam for ground.
As e forget di yam cube, e no no say all di animal wey dey for bush no about am well well, dem don ear about Kosikosi since dem born am wit di yam cube.
Kosikosi no say as im dey tie di wood na so di animal dey pray say make in forget am there because dem no about di magic wey di yam cube get.
Quick quick as kosikosi leif di place wey e get di firewood all of di animal wey dey hi wen e dey pack fire wood come come out come dey look di yam cube.
Lopard look am well e say« uhhhhhhhh dis yam cube must to get plenty planty magic well well« but say e want make everi animal get im own part of di yam cube but e no long reach.
As di lopard dey think how dem go share di yam cube naim di animal dem dey begin fight each or as Kosikosi come remember say im yam cube no dey wit am quick quick e leif im firewood for road and run back go wer e tie dee wood.
As e come wer e tie im fire wood e come see say mani animal dey der, as e see dem, e no no watin to say to di animal but im still sey suprise. first e no no watin to do dean e begin to sing make di animal for di hear in song wey e dey sing so dat di animal no go dey think about di yam cube.
Di sing go like dis!
My small yam cube
My small yam cube
I forget you for bush
My mama and papa don tell say make I no lai you down
Say na onli mai hand I must keep you
But I come forget mai small yam cube
Mai small yam cube
Kosikosi come sing wit veri veri sweet voice wey bi say e bi like dat of angeli di tin come make di animal feel veri sorri for Kosikso, di sing dey sweet sote dem begin dey drum and sing wit am some dey dance and some dey sing wit am.
As kosikosi dey sing na so e dey go near wer im yam cube dey, as all di animal don begin dance and sing e just run catch im magic yam cube come put am inside im klot for belle begin go small small but no animal even no say kosikosi don take im magic yam cube come go.
dean di Lopard just stop to sing and dance say who take di magic yam cube wey dey for ground e come make di or animal wey dey dance come notice say di yam no dey der again. So dem all of di animal stop to dance and sing di Lopard shout again wey di boy wey dey sing come disapare to? Wey am? e shout Lopard no even dey happi again e just dey shout wit bitta voice, di Elephant come laugh »hahahah na dat boy take di yam after e don make us sing im sing finish we no even think about di yam again until im take im magic yam cube.
Quick quick di Lopard say we must run quick quick catch am for road before e reach im house, Lopard come tell Elephant say make im begin dey run after di Kosikosi.
Kosikosi dey run go im house e even leif di fire wood for road for di sake of say im must bring im magic yam come home, as e reach home finish e come tell im mama watin happen for bush, as im mama dey ear watin kosikosi dey talk naim e dey dee in cloth wit indego blue color, after kosikosi ear di stori finish e no say di animal dem go come fin am for house, quick kosikos mama say make im close all di door and window.
True true di tin no even reach ten minit na so di Lopard come fin where Kosikosi dey leif, so kosikosi mama come put indego color for big pot come put am unr one window we im put er for di Lopard, e come take style open dat window so dat if di Lopard come true di window im go fall insi di pot of blue indego colour.
Di Lopard dey run dey run go here and er until e come see one window wey open quick quick di Lopard jump into di window as e na insi di pot e land all in bodi just tuen blue as e see say naim end bi dat e try say make im excape, so e try excape through di back yard begin dey dry im body.
Since dis day naim Lopard come get di blue spot for im head and e nefer ask any aninal make dem go people house again.